Cement News

Kasoa Murder: How Ghana teenagers allegedly kill 11 year old boy wit cement block, bury am for evening rituals

[ad_1]

Kasoa

Wia dis foto come from, Yen

Police for Ghana arrest two teenagers aged 16 and 17 who allegedly murder another boy for money rituals around Lamptey Mills, inside Kasoa.

Deputy Central Regional Police Public Relations officer, Evans Enttie tell BBC Pidgin say de suspects use club and cement blocks on de little boy.De suspects Felix Nyarko, who be 18 years and Nicholas Kini, 19, trick de kid into some uncompleted building wey dem whack am to death.

Reports be say after dem move de 10-year-old victim only identified as Ishmael into uncompleted building dem allegedly kill am so say dem fit use am for de money rituals.

“We find de young boy inside pool of blood…de suspects lie de deceased to de uncompleted building, hit an plus club den cement block” he reveal.

De incident happen for Kasoa on Saturday around 5pm, Kasoa Divisional Police Command no comment officially on the incident and arrests yet.

But videos wey dey circulate dey show say police pick up de dead body for truck inside wey de two suspects also dey inside handcuffs.

Ghana Police Service don put out message on social media wia dey advise children against dealing with strangers.

Social media users for Ghana dey inside shock after de news broke.

Wia dis foto come from, Screenshot

Wia dis foto come from, Screenshot

[ad_2]

Source link